BY JOHN ODEY ADUMA
Afenifere dey South West;
OPC nko?
E dey South West;
Agbekoya nko;
E dey South West.
The parrot’s hunters nko?
Dem too dey South West!
Ohaneze Ndigbo dey South East;
MASSOB nko?
E dey South East;
IPOB dey South East;
And BIM too dey South East;
NDF dey Niger Delta
PANDEF nko?
E dey Niger Delta.
MEND nko?
E dey Niger delta.
Avengers nko?
Dem dey Niger delta
Egbesu Boys of Africa nko?
E dey Niger Delta.
What of Bakassi Boys?
E dey SE, ND and SS,
But when shall we reclaim Bakassi?
MBF nko?
E dey Middle Belt,
And all over Naija, they done
franchise Vigilantes Plc,
And Oga Buhari say anyone
wey snatch your thing,
Not just ballot box,
Make am pay for their life!
ACF nko?
E dey North
NEF nko?
E dey North!
Boko nko?
Dem too dey North
Ansaru nko?
E dey North too!
Abi you forget ISWAP?
Na North dem too dey
and other ECOWAS countries.
Shi’ites dey beaucoup for Kaduna
And all over North and South,
But na Iran dey finance
And remote control am in Nigeria
Almajiris self dey North;
But Miyetti Wahala dey everywhere;
Country people, Fulani herders dey on rampage,
beheading, bagging and soaking
the blood of dogs and baboons
And now dem say Fulani fifle
can now be found in 29 States
And as the colonies dey spread
like wildfire in the harmattan
Na so emirates go dey spread follow am
multiply nyafu-nyafu
And na so Sharia too
go continue to the creep
gradually, gradually
The seven remaining States nko?
Boh, dat na matter of time
Islam go take over am
Abuja nko?
Aaaah! Tai Solarin and Akinola Aguda
help them capture am ‘tay, ‘tay!
Country fifle, wahala dey-o!
*Alogra Adai, ‘tori done wowo again-o!
Una go find the ‘tori inside
Mallam Islam Rehoboam Daura’s book:
THE ISLAMIFICATION, ARABINIZATION,
FULBENIZATION, SUNNINIZATION,
WAHABINIZATION, PAKISTANIZATION,
SYRIANIZATION, YEMENIZATION, SUDANIZATION,
PALESTINIZATION AND THE SHARIANIZATION
OF THE FIRST NATIONS
OF THE UPPER AND LOWER NIGER,
Country fifle, we Obodo
No be Judah and Israel anymore,
But now Israel and Palestine,
Cats and dogs.
But how can Nigeria move forward
Being so bedevilled with extremisms
And divisions?
Boh, welcome to the NEW MIDDLE EAST!
*Elders of the community.
Johnny Boy
ENGLAND, UNITED KINGDOM.
Post Views : 182